True Life Matter: Wetin Make I Do? My One Month Boyfriend No Gree Talk To Me Again? - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday 1 January 2014

True Life Matter: Wetin Make I Do? My One Month Boyfriend No Gree Talk To Me Again?



My people, Happy New Year o! una thank You for the support wey una don dey give me since I start this blog, barely two weeks ago. I dey always happy to see sey the number of people wey dey visit this blog dey increase day by day. Make God bles una for me.

Today, one of una, wey be my friend too don become the first person to write me on wetin I call True Life Matter.

Make una follow chuk mouth for the matter because she need advice urgently.

Dear LaaBee,

Thank You for this opportunity. I meet this boy for October last year but by November, we no dey talk again. Wetin dey disturb me be sey, we no quarrel, just like that, na so, him come dey distance himself from me. I don do everything to make us talk, but the more wey I try, na so him dey back off, so tey, him no dey pick my calls again. This na same guy, wey use him mouth talk sey, him go like make we marry this year o! I come dey wonder wetin happen? Wetin pain me pass be sey, before we start to date, we don be friends for long.

Abeg, wetin I go do, becasue I stll like am.

Una don hear, wetin make she do?

1 comment:

  1. Leave d guy jare, better person go show up soon

    ReplyDelete