Abeg Run If Your Bobo Dey Do This - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday 23 May 2018

Abeg Run If Your Bobo Dey Do This



The rate of killing for two days wey don pass by boyfriends don become something to worry about and e go better say all we sisters shine their eyes well well.

You see one way wey dem take know man wey fit eventually kill you na man wey get inferiority complex. Na inferiority complex go make man to dey use call pushu him babe per minute, per hour(O girl no think say na love)

Man wey get work and wey hold himself no get time to dey use call pushu you. unfortunately many women like make their bae dey call them up and down.

Anyman wey use call dey pushu no dey secure, so him wan know wetin you dey do, who you dey with, where you dey...Na so dem go dey ask; Where are you?, Who is there?, Who is talking at the background? Why are you not picking my call.

My sister, abeg run oo, those ones fit kill you and if you think sey na joke, una kuku hear say na say because Joy no pick her spear parts dealer boyfriend call na him make him killer her.

A word my people dem say is enough for the wise people

No comments:

Post a Comment