Soul E Don Talk Sey Him No Ever Marry Queen Ure - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Friday 10 January 2014

Soul E Don Talk Sey Him No Ever Marry Queen Ure


Soul singer, Soul E don deny sey him ever marry Queen Ure.

Him deny am, for the interview wey him do with Punch Newspaper. According to am, when people dey write sey him marry second wife, him dey wonder when him marry the first wife. make una see as him talk am: 

“My experiences made me grow a thicker skin. I have never been married before. Ure and I had a relationship like every other person, it just didn’t work out. I don’t know why people keep writing that Soul E remarries second wife. Where are the pictures of the said marriage to Ure and why nobody is asking questions?".

Him come talk sey wetin even pain am pass, be sey blogger Linda Ikeji paint am for negative, when she write sey him new wife na banker wey senior am.

Him come talk sey na lie, sey him senior him wife wey also dey bear Linda with 3 years and sey she no be banker but they run one travel agency like him self dey do.






No comments:

Post a Comment