No be God! Man Wey No Fit Swim Don Survive For Sea For 60 Hours - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 7 January 2014

No be God! Man Wey No Fit Swim Don Survive For Sea For 60 Hours



Dis kind miracle, no dey happen everytime, so anytime e happen, make we celebrate am.

Na one Taiwan man so, wey dem dey call Tseng Lien-fa, wey no sabi swim at all, dem sey him stay afloat for 60 hours inside sea after wan kind big wave sweep am comot for where him dey catch baby eels (all those small small fish wey be like maggots inside water).

How e take happen? Him sey “I managed to hold on as the first wave hit me on the chest, but I was overwhelmed by the second and bigger wave”

Him come sey na rescuers come helep find am for beach on Sunday, 46 miles from where the sea wash am comot on Friday last week.

No comments:

Post a Comment