How Ijaw Musician, Wife And Friend Take Die For Autocrash - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Sunday 5 January 2014

How Ijaw Musician, Wife And Friend Take Die For Autocrash



Ijaw Music Industry dey for pain as one of their memebrs, Augustine Kemepade, 38, him wife Fortune and friend, Okumagba Akieyefa, 37 don die for road accident wey shele on Monday along DSC expressway.

Dem sey as the three people kpeme on the spot after their motor summersault plenty times.

Na visit o, dem go visit their friend to celebrate the festive season, after all the enjoyment, na him their friend, the host tell them make them sleep for him house, but them refuse, na so Akeiyefa their friend come sey make him give them lift, na the lift so dem take get the accident.

May their soul rest in peace. Amen



No comments:

Post a Comment