Alu! North Korean Dictator, Kim Kong-Un Allow 120 Dogs To Chop Him Uncle Alive - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Friday 3 January 2014

Alu! North Korean Dictator, Kim Kong-Un Allow 120 Dogs To Chop Him Uncle Alive


Can You Imagine! which kind wickedness be this wey North Korean dictator, Kim Jong-Un commit so?

After him sentence him uncle, Jang Song-Thaek to death for treason, na him e talk sey na dogs dem go release to chop am alive. Chei, this na wickedness! no be only one dog oo, but 120 hungry dogs na him chop dis man with five other people wey dem sentence too to die with am.

Dem sey, na so dem strip Jang naked come throw am inside the cage were 120 dogs wey dem don starve fro 3 days dey, dey wait for food.

As them throw them, fiam! na so the dogs come start to dey chop them until dem chope them finish.

Meanwhile the yeye Kim stand dey supervise as the dogs dey chop him uncle.

Jang and Kim For Public Function

No comments:

Post a Comment