Soldier Don Kill One Danfo Driver For Obalende - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Monday 30 December 2013

Soldier Don Kill One Danfo Driver For Obalende



One driver, with vehicle number LSD 451 XG don kpai today for Obalende, because him insist sey make the soldier wey enter him motor, pay am him money.

According to people wey dey, when the thing shele, the yet to be identified driver refuse to comot him motor from where him park for Obalende Bus Stop, come dey drag with the soldier wey no wear him uniform sey, him must collect him money.

Na so two of them come dey drag oo, na where dem dey drag the issue na, na him the soldier wey dem sey him from Dodan Barracks for Ikoyi, come strangulate the driver.



No comments:

Post a Comment