My Prayer For Una For 2014 - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 31 December 2013

My Prayer For Una For 2014





Baba God, we thank you for this year o! many people start the race, but dem no dey here to finish am. no be sey, na we fine pass or sey we deserve the life pass the, na you make am like that.

As we enter 2014, make you see us through like you don do for 2013. Give us good health, bless us financially and morally. Keep our family together as one. for those wey never marry like me, give us husband wey be your own and wey go make us happi as we go make dem happi.

Baba God, anybody wey wan come deceive us again for 2014, father use holy ghost fire pursue am. (Amen), but that one wey dey true, we pray make you hurry their footstep to come pay bride price. (lolz).

Una thank you my people.

No comments:

Post a Comment