El-Rufai, 103 Others Don Escape Plane Crash Today - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Sunday 29 December 2013

El-Rufai, 103 Others Don Escape Plane Crash Today




Today for be another black sunday, but Baba Godey don do him work again. Na wan Boeing 737 aircraft wey carry 104 passengers and crew memebrs including we former Minister of the Federal Capital Territory, Malam Nasir el-Rufai dem say get burst tyre for Murtala Mohammed Airport, MMA, Lagos.

The aircraft wey belong to aerocontractors comot for Nnamdi Azikiwe Airport, Abuja around 9am, come get burst tyre as he dey land around 10:50 am.

Trust we Malam na, as usual na so him go ontop twitter come tweet about the shele.

Make una see him tweets

for more informate, make una go to: http://www.informationng.com/2013/12/el-rufai-103-others-escape-death-as-aircraft-tyre-bursts-on-landing-at-lagos-airport.html

No comments:

Post a Comment