Incase you still be virgin and you be aspiring Otondo, here na ur ooprotunity to earn yourself a whooping N50,000 naira monthly as we Presido Jonathan through the NYSC Director General, Brig. Nnamdi Okorie-Affia don announce se dem don arrange to pay Virgin Corps memebers N50,000 as montly allowee instead of N19,800.
Dem sey the brain behind am na to help girls keep their virginity for their future husband and as a way of congratulating them.
As I dey write the tory so, dem sey so far na only 28 girls nationwide don dey confirmed sey dem be virgins and them don even start to dey receive their N50,000 allowee.
To make the tory interesting, Laabee hear sey, pharmacies don start to dey report 234% increase for demand of Alum, womanliness tightners and hymen reforming cream and drugs (who wan carry last)
Dem sey male virgins too don dey protest sey them self must follow chop inside the FG bounty, afterall what is source for the gander na sauce for the goose.
But e pain me sey, no be my time dem do this one, I for follow chop this sweet money oo. chei N50,000
No comments:
Post a Comment