Ambrose |
Channelle |
Nick the yeye husband |
Hmmm, its a pity sey we dey allow devil use us anyhow, why Ambrose Monye go allow make devil use am like this. Anyways now wey dem don sentence am to life imprisonment for South Africa, maybe him go repent.
Just incase una no no the matter, the former olympian wey participate for Seoul Olympic game for 1988 kill one 26 year old Channelle Hennings on the 8th of November 2011, when she go drop her son for Morning Star Montessori Preschool wey dey Faere Glen, East Pretoria South Africa.
No be only him dem sey do am oo, dem sey him and another person wey dem don also sentence to life in prison kill the woman after the woman former husband pay them to kill her.
No comments:
Post a Comment