True Life Matter: Se Na True Sey Every Woman Na Potential Lesbian? - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 7 January 2014

True Life Matter: Se Na True Sey Every Woman Na Potential Lesbian?



 Una thank you for the visits to this blog, even though I dey post late because I dey do 8:30am-7:00pm job. (lol)

One of una send me this message sey make I share am. Oya make una answer her!

You self fit share your matter on top LaaBee. just send your email to blaj4ral@gmail.com or blaj4ral@yahoo.com.

Back to the matter, make una hear her story...

'Me and my friend one day dey discuss about the issue of lesbianism, na him she con tell me wetin shock me. she sey, every woman na potential lesbian, if she allow am.

According to her, to know whether na true, every woman dey turn on if them watch lesbian porn or even see where lesbians dem dey do am. true true, me dey turn on, if I dey watch lesbian porn. Se e mean sey me self fit become lesbian if I want?'




2 comments:

  1. Na so me self hear

    ReplyDelete
  2. Na hin own opinion be dat, na individual thing

    ReplyDelete