Technology! This Bra Go Only Remove If The Woman Love You - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday, 28 January 2014

Technology! This Bra Go Only Remove If The Woman Love You


Dis one na him dem dey call tekiinology. One Japanese company wey dem dey call Ravijour don make bra wey man fit only unhook if the woman love am.
Dem sey the bra dey work by monitoring heart rate increases wey dey beat because of hormone levels wey adrenal medulla dey secret.
Dem sey why dem do the bra no to help women know the yeye men wey wan deceive them, sleep with them waka.
Make una hear wetin the bra designer talk…
"It knows how women truly feel.A built in sensor reads the woman’s heart-rate signal and sends it to a special app via Bluetooth for analysis.” Once the bra exceeds the 'True Love Rate' it then unhooks automatically.”

I like this one oo, make I book my order now. (lol)

No comments:

Post a Comment