First Bank Of Uyo Don Close down because Of Juju Banana Tree - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Monday 6 January 2014

First Bank Of Uyo Don Close down because Of Juju Banana Tree

 
We hear sey one of First Bank of Nigeria branch for Uyo town for, Akwa Ibom state don close down, because of juju wey dem palce in front of the banking hall by some people wey dem never identify.

The building of the bank belong to one Joesco Group of Companies and dem sey na him people dey patronise pass because e dey for the heart of the town.

According to gist, dem sey e fit be sey small kwanta dey bewteen the owners of the building and the bank or between customer wey dey vex with the branch management.

But trust naija people na, dem don already go dey withdraw their money from the bank ATM machine, to avoid, sey dem go dey stranded, as nobody know when the bank go open
 
 
 

No comments:

Post a Comment