Praise The Lord! D'Banj & Genevive Don Come Back Again - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 31 December 2013

Praise The Lord! D'Banj & Genevive Don Come Back Again



When the kokomaster fall in love, you know sey water don pass garri. True true, water don pass carry garri oo!

Kokomaster and Genevive don come back again. Infact dem sey aunty Geni don even pack her go D'banj house for Lekki and sey dem don even dey talk about their marriage.

We happy for una o! una go rmember sey dem be dey together from 2009 to 2011, before dem come decide to break up because of sey, Kokomaster eyes still dey up. maybe the eyes don come down now, afterall man no go continue to be small boy every year.

No comments:

Post a Comment