See How Breast Advert Cause 517 Accidents For One Day - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Thursday 16 October 2014

See How Breast Advert Cause 517 Accidents For One Day



This Bobby no go put men for trouble. Na one company so, use Bobby do adverts for Moscow wey don cause 517 traffic accidents for just one day!

The company carry picture of woman bobby plaster for the side of 30 trucks wey dey drive inside Moscow and as male drivers dem dey pass na so dem they loose concentration so tey they come dey jam themselves.

Dem come talk sey as dem don realise themselves, na him the drivers vex come go report the matter to the company wey do the advert, come even dey ask for compensation.

The spokesperson for the company wey the name be Sarafan Advertising Agency expalin sey " We are planning to bring a new advertising format onto the market, encouraging companies to place their ads on the sides of trucks, as we thought this would be a good alternative to putting them on the sides of public transport.'We wanted to draw attention to this new format with this campaign' 'In all cases of accidents, the car owners will receive compensation costs from us that aren’t covered by their insurance."

Nothing man no go hear!

No comments:

Post a Comment