It Is A Lie! Lionel Richie Na Khloe Kardashian Papa? - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Thursday 16 October 2014

It Is A Lie! Lionel Richie Na Khloe Kardashian Papa?



 
First dem sey na OJ Simpson be her papa, now we don dey hear another gist sey, e be like sey na Lionel Richie na him father Khloe Kardashian.

Biko which one we wan believe now.

Intouch dey claim sey one reliable source wey dey close to the musician na him tell them sey Kris Jenner get affair with Lionel for the 80s and sey the affair na him produce Khloe.

The source na Jacky Jasper, founder of blog Diary Of a Hollywood Street King.

Him talk sey, "Everyone was sleeping around with everyone else back then, and Kris was hot in those days.'Kris had an affair with Lionel - and I believe he is Khloe's dad."

 

No comments:

Post a Comment