Wetin Go Carry Man Rape Him Own Pikin - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 16 September 2014

Wetin Go Carry Man Rape Him Own Pikin



The man wey una dey see so na alleged rapist, wey dem sey rape him own 5 year old pikin. Na for Italuwo wey dey inside Ikorodu this one for happen.

Them sey na neigbours take corner eyes see the kukere waka wey him dey do with him daugther come alert other people wey dey for the area, sey make them come follow them see.

When people gather start ask as, him deny sey "How can?" but the little pikin con confirm sey na true oo sey her papa don use her.

Me come follow join the Papa ask, "How Can" na wetin go make man to rape him own daughter, if no be for ritual purpose or sey dem swaer for am from him village...



No comments:

Post a Comment