Abeg How Many Times Generator Fuel Go Kill People Before We Learn? - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 16 September 2014

Abeg How Many Times Generator Fuel Go Kill People Before We Learn?



 


Big wahala don shele again for Ikorodu where Generator fuel wipe out a whole family of 5. This one happen for Ipoyewa community inside Ikorodu.

All becos dem dey try hide the generator inside house from thiefs. Chai, now all of this man family don kpai including am self.

Abeg I take God beg una if you dey read this report, we need to dey very careful plus sey make we allow the set to cool down if we must put am inside house, and even when you do so, make sure sey the room dey well ventilated.


But the best na to make iron cage for your generator outside. Abeg oo, e better self sey dem steal am there than sey you die ontop sey you dey svae the generator.

May their rest in peace. Amen


No comments:

Post a Comment