Make Una Dey Careful oo, Shocking ATM Machine Don Full Everywhere - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 8 July 2014

Make Una Dey Careful oo, Shocking ATM Machine Don Full Everywhere


The other day I tell una how one of LaaBee reader talk sey Access bank ATM machine almost shock am die. Another of my reader don confirm the tory.

According to her, she sey make she go collect money for GTB ATM machine wey dey for Ajah and na so she self experience shock ontop the ATM.

I go advice una biko, if you can avoid to use ATM when rain dey fall, abeg try do so until these banks go find solution to this epidemy of shocking ATM machine...

No comments:

Post a Comment