O di kwa risky! Check Out Dis 8 Months Pregnant Olympian Wey Run 800m Race - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Friday 27 June 2014

O di kwa risky! Check Out Dis 8 Months Pregnant Olympian Wey Run 800m Race

 

Until this moment, me know no sey some people still dey take big risk like this 8 months preganant U.S olympian wey decide sey she go participate for 800m race for Hornet stadium inside Sacramento, Califonia.

The 28 year old five times US national champion, Alysia Montano receive standing ovation after she complete the race for 2 minutes, 32.13 seconds, 35 seconds slower than her personal best of 1:57.34.

And una know wetin she talk when them ask her, if e no dey risky, she talk sey since she get belle she don dey run and she never ever feel bad about am.

Anyways na Doctors sha give her go ahead to dey run, but mehn nke a di kwa risky.

No comments:

Post a Comment