How Access Bank ATM Nearly Shock Me Die Today - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 1 July 2014

How Access Bank ATM Nearly Shock Me Die Today



Nothing wey person no go experience.

One of my readers na him send him complain sey, the ATM of access bank for Ojota area of Lagos state for kill am today out of electricity shock.

Him talk sey, the rain follow cause am as all the keys of the ATM don soak with water. Na so him talk sey make him withdraw and boom na so the thing almost shock am die.

Abeg ooo, me know no sey ATM dey shock, make una sha dey careful.

1 comment:

  1. .......hope say the money no shock am too!!!......Em'

    ReplyDelete