We Army People For Borno Don Revolt Say Enough Is Enough - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday 14 May 2014

We Army People For Borno Don Revolt Say Enough Is Enough



Who Say Soldiers Must Obey To The Last Order? If I hear! Anyways We Soldiers Don Sey Enough Is Enough.
 
Una remember sey the Borno state Governor been talk am sey, Boko haram people dem dey better armed and more motivated than we Army. Well the truth don dey unfold.

Dem sey angry soldiers from the new 7th Division of the Nigerian Army for Maiduguri today, May 14, tell their Oga, The General Officer Commanding, Major General Abubakar Mohammed, sey dem don tire.
 
Dem sey the army dem come start to shoot inside the Maimalari barracks, which na also home to the Artillery Corps, the Ordinance, plus army signals dem inside Maiduguri.

Wetin be the wahala, the soldiers dem dey complain sey their superiors don fail them by not providing them with correct machine guns to take fight the Boko people. sey na thats why Boko people just dey kill their colleagues anyhow.
 
There is God ooo.

No comments:

Post a Comment