Police Don Catch Twins Wey Dey Steal - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 15 April 2014

Police Don Catch Twins Wey Dey Steal

 
When I see this story ontop Punch newspaper, wetin come my mind na the parents of these men wey dey claim sey dem be 27 years.

How can a whole twins be armed robbers if no be swear. Anyways we Olopa dem don arrest them sey dem go rob one factory wey belong to Reckitt Benckiser.

Dem sey na one roberry gang hired the two twins wey be welder to helep break the company warehouse for May last year. the things wey dem collect for the warehouse, dem sey reach N17 million.
 
Although the two don claim ignorance sey dem no know sey na thief work dem hire them to do.

No comments:

Post a Comment