Two People Don Die For Dangote Cement Factory For Benue - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 18 March 2014

Two People Don Die For Dangote Cement Factory For Benue


Two people today don die for Dangote Cement factory wey dey for Gboko for Benue State after katakata burst for the factory ontop sey one of the dead person steal Tyre.
Dem sey as army catch the guy, na so dem him colleague come dey try to escape the guy, but the angry soldier come vex shoot the guy die. Na so oh, katakata come burst.
Eye witness sey him see two dead bodies plus one wey dey seriously injured.
Meanwhile them sey as I dey write so, many of the factory workers dey locked up inside the premises.
Una go remember sey, this kind thing too don shele for the state wey claim thirteen lives including over one hundred trucks.

No comments:

Post a Comment