Presido Don Say Make Dem cancel Last Weekend Immigration Exam - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday 19 March 2014

Presido Don Say Make Dem cancel Last Weekend Immigration Exam


We Presido, Goodluck Ebele Jonathan don order sey make them cancel the immigration exam wey shele last Saturday.

Presido also order sey make Minister of Interior, Abba Moro, refund the N1,000 application fee wey dem collect from job seekers wey write the scam exam.

We presido come even t order sey make them leave three three slots for family of people wey die during the exam.

Na for today Federal Executive Council meeting, him talk all this one. Over 20 people on Saturday loose their lives for to sey dem go write Immigration exam.

May thier soul rest in peace (Amen)


No comments:

Post a Comment