Make Una Check Out The List Of 36 Celeb Wey Don Knack Lindsay Lohan Akpako - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday 19 March 2014

Make Una Check Out The List Of 36 Celeb Wey Don Knack Lindsay Lohan Akpako


Una no go believe, but 27 year old Actress, Lindsay Lohan don sleep with 36 famous men, excluding non-famous ones o! and she don use her hand list them one by one. Chei! Justin Timberlake even follow na akpako.

On January 30 2013, after she don high for Beverly Hills Hotel for LA, Lindsay start to dey discuss how many men wey she don sleep with, so tey she carry pen and paper start to dey list am.

As she forget to burn am or even tear am later, na so somebody pick am for the hotel and low and behold, this na the list:



just incase you know see the list well well, make I list some of them:
Justin Timberlake, Orlando Bloom, Ashton Kutcher, Ryan Phillippe, Benicio Del Toro, Adam Levine, Zac Efron, Joaquin Phoenix, Colin Farrell, James Franco, Wilmer Valderrama, Stavros Niarchos, Danny Cipriani, and many more. 

No comments:

Post a Comment