Can You Imagine? Confab Delegates Dey Ask For Allowee For Aides And Their Drivers Too - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday 19 March 2014

Can You Imagine? Confab Delegates Dey Ask For Allowee For Aides And Their Drivers Too


Although I follow for people wey support sey make we hold national confab, but mehn with yesterday session, e be like sey we go need to call am off.

How can these 'honourable men' dey ask for financial allowances for their aides and drivers after them don pocket 12 million naira each for just coming to solve Nigeria problem wey dem follow cause?

Just for 3 months and them go pay them 12 million and them get mouth to ask for more money for their aides and drivers, chei! this old men and women should please fear God.

Why dem no fit be like Tunder Bakare and Agbakoba wey refuse to collect shi shi for this patroitic service?

I know blame them, na Government wey even offer them the money in the first place. So if money no dey attach to this honourable job to save naija, nobody go show for the confab abi?

Anyways, I thank Senator Ita Giwa wey shun them down sey “We are here to address the problems, we are responsible for most of the problems, and therefore we should sit down and do the work rather than asking government to do this or that.” 

Infact, I for like make them comot that yeye Senator Mohammed Jibrin wey ask how many aides make them employ.

Oti, you for go carry all your villagers as aides, because you dey go conference where na sleep self you go go do. yeye dey smell.




No comments:

Post a Comment