Dem Don Begin Search For Malaysian Aeroplane Wey Vanish With 227 Passenger 2 Hours After Takeoff - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Saturday 8 March 2014

Dem Don Begin Search For Malaysian Aeroplane Wey Vanish With 227 Passenger 2 Hours After Takeoff


Dem don Begin Search for the Malaysian Airlines jet wey carry 239 people including passengers and crew members after the plane loose contact flying from Kuala Lumpur to beijing.

Dem sey the aeroplane for land for Beijing for 6:30am local time, but after 7:54am na him the airline issue statement sey the plane never land and sey dem no see am again. 

The people wey dey on board them include, two infants and 12 crew members.4 Americans 7 Australian passengers, 153 Chinese, 38 Malaysians, 12 Indonesians and 32 people from France.

1 comment: