Mary J.Blige Papa Dey Critical Condition Now After Him Ex-Gf Stab Am Three Times - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Friday, 24 January 2014

Mary J.Blige Papa Dey Critical Condition Now After Him Ex-Gf Stab Am Three Times



Singer Mary J Blige papa, wey dem call Thomas Blige dey for critical condition now for one hospital for Michigan after him ex-girlfriend stab am three times yesterday morning.

According to report, dem sey the 63 year old man get small quanta with him 50-year-old ex, because him think sey she slash him car tires.

Dis no be the first time sha wey this kind of domestic quanta dey happen between them, infact them sey dis na like the seventh time.

Wey hope sey after this one, dem go learn to stay far away from themselves. get well soon.


No comments:

Post a Comment