Popular Radio Presenter, Dan Foster Don Talk Why Him Dump Linda Ikeji - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 4 November 2014

Popular Radio Presenter, Dan Foster Don Talk Why Him Dump Linda Ikeji

Just incase una no know, Popular radio presenter, Dan Foster been kpeke Linda Ikeji. But unfortunately the kpeke no come end for marriage, because him dump Linda go marry another woman.

Anyways, the presenter recently grant interview with one wedding website. And when dem ask am, why him no marry Linda, him come yarn sey Linda na nice and honest 'kid', but sey him no good for Linda becos of him wayward life back then (I no know about now sha).

So tey, even when him dey kpeke Linda, him dey also colobi other side chicks.

Wetin come make me dey eyes brow, be sey him sey as many times wey him don try to code Linda number ontop him phone, him wife dey always find out. Abeg, shey him still get feelings for Linda, abi Linda too still get feeling from am?

 This love matter self

Dan and him family

No comments:

Post a Comment