Gobe! Anambra First Lady Slap Wife Of Deputy Governor - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday, 19 November 2014

Gobe! Anambra First Lady Slap Wife Of Deputy Governor

Ermmm biko I no dey there when e happen, but na hear I hear am sey the wife of Anambra State Governor, Her Excellency, Chief (Mrs.) Vickie E. Obiano Slap the wife of the Deputy Governor of the state, Nkem Okeke, for in front of igwenmadu (public in igbo).
Na wetin cause the slap? dem sey trouble start when the deputy Gov wife report Vickie to Lady Beatrice Ekweme the wife of former vice president, Dr Alex Ekweme, sey Vickie no sey carry her along at all at all.
Na so oo, Lady Beatrice come sey make she intervene, advice vickie to carry her fellow lady along. But as soon as Lady Beatrice start to advice her, na so she kopu(mad) come dey vex, dey para sey why she go tell her that kind of thing, sey afterall the constitution only recognise the office of the First lady.
Na so she match go meet Nkem, come dey shout for her sey make she no ever try report her again. That one too come angry, start to shout back at her. before we know wetin dey happen, Vickie just land Nkem one correct hot slap 

Mehn if na true sey this one happen, she fuck up big time.

No comments:

Post a Comment