#StopEbolaStigma: Just See How This Liberian Woman Kill Herself Because Of Stigma - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Friday 12 September 2014

#StopEbolaStigma: Just See How This Liberian Woman Kill Herself Because Of Stigma



Na one Liberian woman wey dem dey call Kate, na him dey sey hang herself oo, because of the way wey people around her start to treat her after Patrick Sawyer carry Ebola enter Naija.

Dem se before Patrick Sawyer come oo, sey she no get wahala with anybody for around  Bankole Street, Isheri-Oke, Lagos wey she dey stay, but because she been dey sick small small before Patrick enter naija, na him make people around come begin avoid her.

So tey, people come stop to dey sell things to her. Na out of frustration na him many residents for the area think sey she come kill her self.

Abeg make we stop this stigma, if we suspect any case na to report the matter to the helpline for Ebola wey we government don provide. And after them treat any Ebola person, abeg make we help am come back into our community fully instead of to dey stigmatise.

No comments:

Post a Comment