Mend Don Talk Sey Mr Ebikeme Clark Stage Him Own Kidnap To Collect N500million Form Delta State Government - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 8 April 2014

Mend Don Talk Sey Mr Ebikeme Clark Stage Him Own Kidnap To Collect N500million Form Delta State Government


Movement for the Emancipation of the Niger Delta (MEND) don accuse Chief Edwin Clark pikin, Ebikeme Clark sey na him stage him own kidnap so make Delta state government pay N500m for him ransom.

Mend even talk sey, Delta state government part with the money to secure him release

However, the Delta state government don react to the report talk sey dem no pay any shikram to release Ebikeme

Question be sey, who we wan believe now. for MEND to talk this one, se bi na person wey dey follow live inside house no the corner of the house. Fo Naija, anything can happen!

Meanwhile sha, we Olopa don arrange some suspected group of guys wey carry out the kidnap

No comments:

Post a Comment