FG Don Talk Sey Dem Go Ban Nigerians From Using Candle Or Kerosene Lantern - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Friday 11 April 2014

FG Don Talk Sey Dem Go Ban Nigerians From Using Candle Or Kerosene Lantern


We Federal Government don talk from 2015 next year, dem go start to replace the use of domestic candles and kerosene for many homes with solar energy lamps.

Na the Minister for Environment, Mrs. Laurentia Mallam reveal the secret for when senior officials of Total Group pay her courtesy visit inside her office.

She tell them sey the old household lights them go vanich kpatakpata so that we environment go dey more ozone friendly

Hmmm. so e mean sey even government never ready to give us light, so tey na solar energy lamps dem dey plan for us. Make them kukuma ban generating set also give us power supply.

No comments:

Post a Comment