Tyler Perry Dey Look For Him Real Papa - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday 19 March 2014

Tyler Perry Dey Look For Him Real Papa


After him find out sey him mama lie for am sey Emmitt Perry Snrup be him papa, Tyler Perry don start to dey look for him real papa.

Perry discover sey Emmit no be him papa after him take DNA test with him bother.

Before now, Perry don dey wander why him supposedly papa dey always beat am anyhow when him small, only to come find out now sey true true, the man no be him papa.

Chei why the mama come lie na.

No comments:

Post a Comment