Gbese! LASTMA Officer Slap Chief Magistrate! - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Friday 7 March 2014

Gbese! LASTMA Officer Slap Chief Magistrate!


Olopa don arrest one LASTMA officer wey him name na Taye Shittu because him go slap one Chief Magistrate, Mrs Komolafe Abimbola of Court 2 Ikeja, Lagos.

Dem sey Shittu accused the chief magistrate sey she no obey traffic light, but after the woman, jejely come out from her car, na him arguement begin, na so Shittu throway slap on top her face. (Igbosa), so tey she even sustain injury from the slap.

Now tell me wetin una think go happen to Shittu. You don enter one chance my brother, next time ask who person be, before you slap. lolz


No comments:

Post a Comment