Miracle Pikin: This New Born Baby Survive After Him Mama Catapult Am From Womb When One Big Truck Jam Her Come Kill Her - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Friday 21 March 2014

Miracle Pikin: This New Born Baby Survive After Him Mama Catapult Am From Womb When One Big Truck Jam Her Come Kill Her



Na who sey God no dey work? Our God dey work for mysterious way o! how we wan explain sey this baby wey una dey see so, na catapult him mama catapult am comot from womb after one yeye truck driver go jam am, come kill her.

Dem sey the baby, wey dem don name Xiao Zhao catapult three meters out from him mama womb.
According to the family of the baby mama, 40-year-old Wang Zhau enter labout around 8:30am, na so her husband come kukuma carry her for him okada to take her go hospital.


Na as dem they on their way to hospital, na him the truck come hit them comot for the motorbike. As the truck hit them comot, na so the truck still climb ontop the woman, wey make her catapult the pikin comot from her womb.

More foto from the accident


No comments:

Post a Comment