So for all of una wey been dey ask, wetin be the challenging role, President Jonathan won give the immediate past chairman of the PDP, Alhaji Bamanga Tukur, Dem don appoint am now as the Chairman board of Nigerian Railway Corporation.
This one no be first time wey Tukur go head for Federal government parastatals. Infact one of the things wey bring am for limelight na as him take work when him be general manager for Nigerian Ports Authourity.
And him also been head as Chairman of NEPAD Business Group and Executive President of African Business Roundtable (ABR).
Many people belive sey this new role suit am pass the rofo rofo politics wey he been wan use spoil him career.
We hope sey him go bring him expertise to make Railway work at last.
No comments:
Post a Comment