Talk True: Se Kim & Kanye Pikin North West Ugly? - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday, 21 January 2014

Talk True: Se Kim & Kanye Pikin North West Ugly?


wowo+ugly=wogly, yes Joan Rivers na wogly in all magnitude. and she get mouth to call Kim and Kanye pikin North West ugly.

The woman no dey shame self, calling small pikin ugly all in the name of joke.

The 80 year old agbaya for her latest stand up comedy routine for Saban Theatre, joke sey when she meet Nori, as Kim bring her come her office for E! television network, the pikin ugly.

See as she talk am
'That baby is ugly... I've never seen a six-month-old so desperately in need of a waxing.' 
But jokes apart, una don see any ugly pikin before? me think sey all pikin fine o!

No comments:

Post a Comment