Atuwala! Desmond Tutu Don Talk Sey If Gay People No Dey Heaven, Him Go Rather Go Hell! - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Friday, 17 January 2014

Atuwala! Desmond Tutu Don Talk Sey If Gay People No Dey Heaven, Him Go Rather Go Hell!



Ahead of South Africa election wey go shele April-July, this year to elect new National Assembly as well as new provincial legislature for each province, Nobel Peace Prize laureate and South African Archbishop Desmond Tutu don form him own political party for Gay people wey him call Democratic Religious Alliance Against Minority Antagonism (DRAAMA).

Dat one no be all o! Tutu even talk sey him go rather go hell fire than to go heave where dem no allow gay people enter. see as him talk am

“I would refuse to go to a homophobic heaven… No, I would say sorry, I mean I would much rather go to hell… I would not worship a God who is homophobic and that is how deeply I feel about this.”

 According to the man of God, him sey him no believe sey religion get any justification for homophobia.

Nna mehn, if man of God talk this one, wetin make we congregation talk na.

make una read more Here

No comments:

Post a Comment