Catholic Priest Don Ask Kumuyi Whether Him No Dey Celebrate Him Birthday - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Monday, 23 December 2013

Catholic Priest Don Ask Kumuyi Whether Him No Dey Celebrate Him Birthday






The Director of Social Communication, Catholic Archdiocese of Lagos, Monsignor Gabriel Osu don ask Pastor Kumuyi wey say make him members no celebrate Christmas, say shee himself no dey celebrate him birthday?

Him come come say, if Kumuyi dey celebrate him birthday, why we no go celebrate the birth of Jesus Christ?

The Deeper Life General Overseer, for their annual National December Convention, on Saturday, been tell him church members sey make dem no celebrate Christma because na idolatry.


Na wa oo, wetin we no go hear!

No comments:

Post a Comment