Beer Parlour Go Hear Am, As Mountain Of Fire Begin Crusade To Fire All Beer Parlours - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Thursday, 19 December 2013

Beer Parlour Go Hear Am, As Mountain Of Fire Begin Crusade To Fire All Beer Parlours

 Dis na to announce to you, the death of all beer parlour joints for Obodo Naija, as Dr Daniel Olukoya-led Mountain of Fire and Miracle Ministries church, MFM, don tie wrapper to finish una with holyyyyy Ghost fire.

Beginning today, una no go see customers oo, because dem don embark on a crusade to make sure say una no go sell.

for their mind, if dem succeed (se dem fit?) e go helep reduce the kingdom of satan, wey dey start from drinking. afterall drinking and crime dey go hand in hand (no be me talk am oo, na so e dey for their bible).

Dem tag the crusade overcoming the storm. Na wa oo.


No comments:

Post a Comment