Breaking News...Linda Ikeji blog Don Disappear! - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday 8 October 2014

Breaking News...Linda Ikeji blog Don Disappear!

 
Me no know wetin dey happen, but as I dey tell you now, we no fit access popular blogger, www.lindaikeji.blogspot.com blog again.

Dem sey e be like sey Google na him yank am off, but Linda been talk something about moving to
another site.

Earlier last week, Linda been get small qwanter with one blogger wey him name na Mr.Aye Dee and Google over copyright material.

But as Google dey touchlight the matter na him, Linda come release personal infomention about the man talk sey him dey jealousy her.

I suspect se na him make google don clear her blog commot




Chai, this no be good one. Abeg make una forgive and forget  #BringbackLindaIkejiBlog!

No comments:

Post a Comment