Again! Boko Haram Don Pushu Army People For Their Mubi Headquarter - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday 29 October 2014

Again! Boko Haram Don Pushu Army People For Their Mubi Headquarter

 No be small thing today! If una see how members of  Boko Haram take enter army headquarters of 234 battalion for Mubi town for inside Adamawa state, una go no sey truly, we government dey play with this their truce talk.

Truce for where? Na so dem start to dey shoot, kpu  kpu kpu, dey scatter everything scatarrable. Finally sha, as the soldiers wey dey when the fight dey happen see say the thing don passdem, na so dem benjosin.

As we dey talk so na, dem sey boko haram don take over the headquarters.

Infact the sect today also attack Uba and Hildi town for Borno and Adamawa states this morning.

Me come dey ask, which Boko haram, FG dey negotiate with. The fake one?

No comments:

Post a Comment