#My2kobo Ontop Dis Year National Award - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Tuesday 30 September 2014

#My2kobo Ontop Dis Year National Award

 Akinkunmi
Except for some people sha (them no plenty),  me think sey most of the people wey get this year national award make sense.

Plus I like the idea sey, we Presido take time to remember the designer of our national flag,Pa Micheal Akinwunmi, wey no other Presido don do.

The fact sey him also make Pa Akinwunmi one of him Special Assistant and place am for life time salary make sense die. This na how to reward good work, abi no be so?

I also like sey the president also recognise him personal cook, the taxi driver wey return person N18m and a traffic warden. All this small but might gesture from we presido, come follow make me talk sey truly this year award make sense.

My only but,  na sey dem for also consider Dr Adadevoh we helep us make sure sey that mad man, Patrick Sawyer no finish us with Ebola.


 Abi wetin una think? 

No comments:

Post a Comment