No Smoke For Public Place o! Except You Wan Spend 6 Months Inside Prisonment Or Pay N50,000 - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday 9 April 2014

No Smoke For Public Place o! Except You Wan Spend 6 Months Inside Prisonment Or Pay N50,000



We Federal Executive Council today don approve the draft of National Tobacco Control Bill of 2004 wey them go send go meet we National Assembly as Executive Bill for them to look am well well pass am into law.

For inside the bill, dem recommend sey anybody wey dem catch dey smoke for public places go go prison for minimum of 6 months or pay N50,000 or even go prison pay the money too join.

So me come dey ask, why you no go respect yourself quit the smoke, if to smoke go carry you enter prison. Make una remember smoking dey kill oo.


No comments:

Post a Comment