Presidency Don Talk Se Defence Minister, Aliyu Gusau Never Resign - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Wednesday 12 March 2014

Presidency Don Talk Se Defence Minister, Aliyu Gusau Never Resign


I no Know where the story take come out from sey we newly appointed Defence Minister, Aliyu Gusau don resign him appointment barley one two weeks wey dem appoint am.
But the spokesperson for President Jonathan, Rueben Abati don talk sey na lie. 
When them ask am sey, why Gusau no come today Federal Executive Council meeting, Rueben sey na because Gusau get Flu (hmmmmm).
Well make we believe am, as Gusau himself never come out to deny am or sey true true him don reply.
Make una remember sey for naija, anything can happen.


No comments:

Post a Comment