My 2Kobo Ontop This Confab Matter - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Thursday 27 March 2014

My 2Kobo Ontop This Confab Matter

gay talkative

Me no just understand these old men and women wey dem tell to represent us for confab. some issues sha wey no dey relevant na him dem just dey talk about.

How can someone like the Lamido of Adamawa dey threaten sey him and him people go leave Nigeria to Cameroon. Se him think sey Cameroon people go welcome am with open hands?

Then this one wey dem call Abdul Mahmud, President Public Interest Lawyers League, no see wetin to go push for, for the confab, na to go push for gay rights. Se na dat one be our headache.

Biko if una no go fit do this work, Ka agbasa the Confab, ka onye obunna na ibe ya. (Lets stop the confab and let everyone go there house.


No comments:

Post a Comment