Hong Kong Billionaire Don Double Reward For Any Man Wey Fit Make Him Lesbian Daughter Become Straight. Hmmm...Who Wan Try? - Una Welcome to LaaBee Blog

... De #1 Ogbonge Pidgin Blog For All Your Aproko | Fashion | Lifestyle | True life tory

Friday, 24 January 2014

Hong Kong Billionaire Don Double Reward For Any Man Wey Fit Make Him Lesbian Daughter Become Straight. Hmmm...Who Wan Try?

Gigi and her lesbian partner

Chei agony of papa! Hong Kong billionaire Cecil Chao, don offer another whooping $130million to any man wey fit make him lesbian daughter, Gigi Chao fall in-love with am and marry am.

Una go remember sey the billionaire businessman been don offer $65million for Sept 2012 to any man wey fit change him daughter from lesbian to real woman.

But after every sha, no man don fit do as him want. dem sey many men try o. only sey the girl winsh too strong, infact dem sey about 20,000 suitors try, but e no work.

Anyways I no sure sey Nigerian men been try, because I no sey if to sey dem try dem go get her. Anyways this na another chance for una to try.

Make una read the interview wey him garnt recently and him daughter interview too with Malaysian newspaper.

 For recent  recent interview with Financial Times, Mr Chao sey:
"I will give them a moderately deluxe life. I would not force her to marry a man, but obviously I would prefer her to be married and give me grand children"

Gigi Chao for interview with Malaysian newspaper, sey;
“I don’t think my dad’s offering of any amount of money would be able to attract a man I would find attractive. I would be happy to befriend any man willing to donate huge amounts of money to my charity, Faith in Love, provided they don't mind that I already have a wife. Third and lastly, thank you daddy, I love you too.”


No comments:

Post a Comment